“ ‘Make una use mud build altar for mi kon sakrifice una animals and do peace ofrins for mi. Anywhere wey una for honor my name, I go kom meet and bless una for der.
make una give mi one melu, one ram, one sheep or goat as burnt ofrin. Nor bi sakrifice to pay una vow or free will or first ofrin; put na ofrin wey God like en smell,
di man must take en wife to di priest and e must bring di ofrin wey woman nid to give wey bi: one from evry Efah barley wey dem divide into ten. E nor go pour olive oil on-top or put any incense, bikos di ofrin na for pesin wey yu suspet and yu won know di trut.
But una sey e dey okay for pesin to tell en papa and mama sey, ‘Make yu nor vex, I nor fit help yu, bikos di money wey I suppose give yu, I don gi-am to God.’
My brodas and sistas, God dey good. So Abeg, as una dey alive, make una dey offa una body gi-am as sakrifice. Make una dey do wetin E tok and wetin go make belle sweet am. Na dis bi di best way to serve God.