Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Levitikus 1:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 E go hold di feada kon tear di body open. E nor go allow di feada fall komot, den e go burn evritin for di altar. God like dis food ofrin smell well-well.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Levitikus 1:17
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So Abram take all of dem go gi-am kon kut dem into two, den e put di two side face each oda, but e nor kut di birds.


Di ofrin smell kon make belle sweet God, so E tell ensef, “I nor go ever curse di eart again, bikos of wetin human being do; even doh I know sey since wen I kreate dem, na only bad tins dem dey tink. I nor go ever distroy evritin wey get life as I don do so.


Bikos God nor go leave my soul inside grave or allow en holy pikin rotin for der.


Di man wey dey give di ofrin must wosh di animal intestine and legs, den di priest go burn evritin for di altar. God like dis food ofrin smell well-well.


kon take am go give Aaron sons wey bi priest. Di priest go pak di flower, oil and all di incense full en hand kon burn am for di altar as part of di ofrin wey dem give God. God like dis food ofrin smell well-well.


Di priest go burn all of dem for di altar with di burnt ofrin. God like dis food ofrin smell well-well.


E go bring dem kom meet di priest, wey go first offa di bird for di sin ofrin kon break en neck, but e nor go komot di neck from di body.


“ ‘Dis na di law for korn ofrin. Aaron sons go present am before God for di altar front


Afta Moses don wosh di intestine and di leg with wota, e kon burn all di ram on-top di altar as komplete ofrin. Na burnt ofrin wey dem give to God and God like am well-well. So, Moses do as God kommand am.


Dem give Aaron di head and di oda pieces for di animal and e burn dem for di altar.


make una give mi one melu, one ram, one sheep or goat as burnt ofrin. Nor bi sakrifice to pay una vow or free will or first ofrin; put na ofrin wey God like en smell,


For evening, make una give di sekond lamb as una take give di first ofrin togeda with en wine ofrin. Na food ofrin e still bi and God like di smell well-well.


Wen e don taste di wine, Jesus kon sey, “Evritin don finish.” Den e bend en head down, kon die.


Na awa sins make God give Jesus Christ to dem make dem kill-am and God raiz am from deat, so dat e go make us raitious pipol.


Bikos of sin, Christ sofa. En wey nor do bad, sofa for doz wey do bad, so dat e go karry us go meet God. And wen dem kill-am, e wake-up as spirit.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ