Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Lamentashons 5:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Wi don make agriment with Egypt and Assyria pipol, so dat wi go get enough food to chop make honga nor for kill us.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Lamentashons 5:6
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

One day, Abraham tell en savant wey old pass, di one wey dey guide di house sey, “Make yu put yor hand under my lap.


Wen e komot from der, e meet Jehonadab, Rekab pikin wey dey find am since. Jehu greet am kon ask, “Yu get respet for mi, just as I get for yu?” Jehonadab ansa, “Yes, I dey respet yu!” Jehu kon sey, “If na so, den shake mi.” So Jehonadab stresh en hand and Jehu kon karry am enter en horse.


Una dey put perfume and oil for body go woship Molek wey una dey koll god. Bikos una dey find gods to woship, una dey send messenjas go far, even go rish where dead body dey.


Wetin una go gain if una go back to Egypt go beg dem to kom help una? Wetin una tink sey una go gain, if una go Assyria go beg to drink wota from Eufrates River?


Wetin make una dey waka anyhow and dey shange una ways? Just as Assyria pipol disgrace una, na so too Egypt pipol go do una.


Make una shaut for war for evriwhere for di town! Den, Babilon pipol go surenda. Dem go skata di town wall, bikos mi wey bi God, dey take revensh. So make una trit am, just as e trit odas.


Naw, awa eyes dey pain us well-well, bikos wi dey wait for pipol to kom help us. But wi just dey wait for nor-tin, bikos dem nor go fit help us.


bikos e don break di agriment wey e make. E do all dis tins and naw, e nor go eskape am.”


Na breeze Efraim pipol dey chop. Dem dey porshu breeze from morning go rish nite. Dem dey gada lie and wahala kon enter agriment with Assyria and dey do business with Egypt pipol.


Wen Israel si as e dey sick and Judah si as e sore big rish, dem kon go meet Assyria great king make e kom help dem, but e nor fit cure or heal dia wound.


Efraim pipol dey waka up-and-down like bird wey dem dey kwik deceive; dem koll Egypt pipol make dem kom help dem fight; but afta, dem run go koll Assyria pipol too!


Israel pipol nor go stay for God land again, but dem go-go back to Egypt, den for Assyria, dem go chop food wey dem dey forbid.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ