Wimen wey dia husband go die, go plenty pass san-san wey dey near wotaside. I go kill una yong men for aftanoon kon make dia mama sofa. Na mi make dem dey sofa and fear go katch dem well-well.
But naw, make honga kill dia shidren and make dem die for war. Make di wimen luz dia husband and shidren; make diziz kill di men and make di yong men die for war.
Assyria pipol nor go fit save us and awa shariot nor go fit protet us. Wi nor go ever tell juju again sey, ‘Na yu bi awa god!’ Na Yu God dey save doz wey nor get papa and mama again.”