Listin to wetin mi, Israel God wey dey mighty, dey tok. “Dem nor go hear joy, happiness and marriage nois. Di pipol go dey alive to si all dis tins wen e dey happen.”
For Judah town and Jerusalem street, I go make sure sey nobody dey shaut or happy with joy sey pesin dey marry. Dis na bikos di whole land dey empty and dirty don full der.”
I koll all di pipol wey love mi make dem help mi, but instead, dem kom deceive mi. Na honga kill my priests and leaders for di town wen dem dey find food wey dem go chop.
Jerusalem road dey mourn, bikos nobody dey pass der go celebrate again. Di town gate kwayet and pain won kill di priests dem. Di yong wimen dey kry, bikos di trobol wey dem dey face, too mush!
I go ponish am for all doz times wey e forget mi kon dey burn incense give Baal and dey run follow en lovers with all di gold wey e wear. Mi, wey bi God, don tok.
So, di pipol wey dey play harp, sing music, blow flute and trumpet, dem nor go ever hear dia sound from yu again. Doz wey get handwork and business pipol, dem nor go ever si dem inside yu again. Pipol wey dey grind tins, dem nor go ever hear dia nois inside yu again.