Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Lamentashons 4:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Before-before, dia prince dem shine pass snow and white pass milk. Dia body smooth pass rubi stone and wen yu si dem, dem dey shine pass safaya stone.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Lamentashons 4:7
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di gold and jewel wey fine pass nor get value rish wisdom.


Wisdom get betta value pass diamond or fine glass.


Make awa sons prosper for dia yong age like betta plant wey dem put fertaliza. Make awa dotas bi like betta pila wey dem karve for palis.


So make Yu klean mi from my sins and I go dey klean; make Yu wosh mi and I go white pass snow.


and dem si Israel God. Sometin wey bi like karpet wey dem take safaya stone make dey under en leg and e klear like sky.


My love fine well-well and e dey strong; e betta pass 10,000 pipol!


En leg bi like pila wey dem design with marbol and gold; while en face bi like cedar for Lebanon.


Wen ten days don finish, dia body betta and dem get flesh pass di yong men wey dey chop and drink di royal food and wine.


bikos God go use am well-well. E nor go drink wine or strong drink, but di Holy Spirit go dey inside am, even before dem go born am.


Afta yu don born am, make yu nor ever kut en hair, bikos from di day wey dem born am, dem go dedikate am give God as Nazirite. E go save Israel pipol from Filistia pipol hand.”


But e tell mi sey, ‘I go get belle kon born boy.’ E still sey, ‘Make I nor drink wine or any strong drink or chop food wey dem dey forbid, bikos from di day wen I go born di pikin go rish di day wey e go die, dem go dedikate am give God as Nazirite.’ ”


so e tell am di trut at last. E sey, “Dem neva kut my hair wons, bikos wen dem born mi, dem dedikate mi give God as Nazirite. So if yu kut my hair, my pawa go leave mi and I go kon dey weak just like anybody.”


So Jesse send for am. Di boy fine well-well, e strong and get fine eyes. God kon tell Samuel, “Na en bi dis! Make yu go anoint am!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ