Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Lamentashons 4:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 Edom pipol wey dey stay for Uz land, make una dey laf naw. Make una know sey dis judgement cup go rish where una dey too; una go drink from am until di drink don shark una and una go kon naked.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Lamentashons 4:21
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God sofa Judah pipol, bikos of King Ahaz for Israel wey enkourage Judah pipol to sin and disobey God.


E get one man wey dem dey koll Job, e dey stay for Uz land and e dey do wetin God wont. E dey serve God with klean belle and e nor dey do bad tins.


My God, make Yu remember wetin Edom pipol do wen dem kon distroy and karry Jerusalem pipol komot from dia own land. Dem dey shaut, “Make una skata Jerusalem rish groun! Skata di town rish groun!”


Yong man, make yu happy as yu dey yong! Make yu enjoy evry minute for dis life and do evritin wey yu won do; but remember sey yu go tell God evritin wey yu dey do.


God still sey, “Even doz wey I nor suppose ponish, go drink from di ponishment cup. Abi una bin tink sey I nor go ponish una? No! Una must drink from dat cup!


Dis na wetin God wey mighty tok about Edom: “Teman pipol nor sabi judge well again? Who dey advise Edom nor fit tell dem wetin dem go do? Abi all dia sense and wisdom don vanish?


Dis na wetin God wey get pawa dey tok: Una klap una hand kon dey jump with happiness and dey curse Israel land.


God wey get pawa sey: “Bikos Moab pipol sey Judah bi like di oda kountries,


“Man pikin, dis na wetin Tyre pipol dey tok about Jerusalem. Dem sey, ‘E get pawa before bikos of en money, but naw wey di town don skata, wi go get plenty money kon strong pass am!’


God sey, “Edom pipol don too sin, so I go ponish dem naw, bikos dem kill Israel pipol wey bi dia own brodas and dem nor sorry for dem at-all. Dem vex kill dem anyhow and dem nor dey taya.


Dis na di vishon wey God give Obadaya about Edom pipol. God send en savant kom di nashons and dem hear di message wey God give dem sey: “Make una ready! Make una gada una sojas go fight Edom pipol!”


Una, Shafir pipol, make una naked make shame katch una as dem dey karry una go as slave. Doz wey dey Zaanan nor go try am kom out from dia town. Wen una hear Bet-Ezel pipol dey kry, una go know sey dem nor even get who to help dem.


Instead make dem honor una, na disgrace go follow una and na una by unasef go drink kon stagga fall. God go make una drink from una own ponishment cup and una honor go turn to disgrace.


Look! I go kom like tif! God don bless di pesin wey go shine en eye and wear en klot, so dat e nor go naked waka.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ