Lamentashons 4:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
2 Just as gold dey important and get value, na so too Jerusalem shidren dey important before, but naw, pipol dey trit dem like ordinary pot wey dem make with klay.
kon tell dem, ‘Oga God wey dey mighty sey, “Just as Jeremaya take distroy dis pot, na so too I go distroy dis town and di pipol wey dey stay inside. Dem go beri pipol for Tofet, until place nor go dey again to beri pipol put.
I sey, “King Jekonaya go bi like pot wey break wey dem trowey. E go bi like klay pot wey pipol nor won use at-all. Why dem go force en and en shidren go anoda kountry? Wetin make dem won take dem go kountry wey dem nor know anytin about?”
Si yong and old pipol don die for di street. Enemies don kill both boys and girls. Yu don kill dem, bikos Yu dey vex and Yu nor sorry for dem wen Yu dey kut dem.
Wen yu go rish man house, nor bi only gold and silva tins dey der, but tins wey dem use wood and klay take make still dey der too and some dey make di house fine and odas nor good at-all.