Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Lamentashons 4:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 Naw, awa eyes dey pain us well-well, bikos wi dey wait for pipol to kom help us. But wi just dey wait for nor-tin, bikos dem nor go fit help us.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Lamentashons 4:17
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Egypt king with en men nor komot from dia land again go fight, bikos Babilon king don konker evriwhere wey Egypt king bin get before from Egypt wotaside go rish Eufrates River.


Pipol wey trust Ethiopia and bilive sey Egypt go save dem, go fear and shame go katch dem.


Di agriment wey una make with deat, nor go work again and dem go kansol di one wey una enter with dead body. Wen judgement go kom like strong wave, e go karry una go.


Wetin una go gain if una go back to Egypt go beg dem to kom help una? Wetin una tink sey una go gain, if una go Assyria go beg to drink wota from Eufrates River?


Wetin make una dey waka anyhow and dey shange una ways? Just as Assyria pipol disgrace una, na so too Egypt pipol go do una.


Una go kover una face with shame and sorrow wen una dey kom back from Egypt, bikos God don rijet di pipol wey una trust and even with dia help, e nor go still betta for una.”


But di pipol kon kry sey, “Dry sizin and harvest time don kom go, yet nobody kom save us.”


I koll all di pipol wey love mi make dem help mi, but instead, dem kom deceive mi. Na honga kill my priests and leaders for di town wen dem dey find food wey dem go chop.


Even inside en pain, Jerusalem remember wen e nor get money or house to stay. E still remember all di propaty wey e bin get. But naw, en enemies don attack am and nobody gri kom help am. Di way e take fall, dey make en enemies laf.


Wi don make agriment with Egypt and Assyria pipol, so dat wi go get enough food to chop make honga nor for kill us.


Israel pipol nor go ever go meet dem for help again. Bikos of wetin go happen to Egypt, Israel pipol go kon know sey, e nor even dey rite to go Egypt for help. Den Israel pipol go know sey na mi bi God wey get pawa.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ