Wen E shaut for war, e bi like river wey dey distroy tins or wey kover pesin rish en neck. E go shake di pipol like tray wey dem take dey separate rice from en kanda. E go put rope for dia mout kon distroy dem.
Why Yu make us komot from yor plans and ways? Why Yu make us sturbon like dat, sotey wi turn from Yu? Make Yu kom back, bikos of doz wey dey serve Yu and bikos of di pipol wey bi yor own.