53 Dem trow mi inside one pit kon dey drop stone for my head.
Dem put mi for undagroun prison and I tey well-well for der.
But naw my oga, make yu listin to mi kon do evritin wey I dey beg yu. Make yu nor let mi go back to dat prison wey dey Jonatan house. Bikos if yu send mi go back, I go die for der.”
So dem tie mi with rope kon drop mi small-small for inside Prince Malkijah well wey dey di palis. Di well dry bikos wota nor dey inside.
“My oga, wetin dis men do so, nor good o-o. Dem don put Jeremaya inside well, where dem know sey honga go kill-am, bikos food nor dey di town.”
Dem remove di stone from di pit mout and di king put en own royal seal with en royal men own, so dat nobody go kom save Daniel.
Den di king go back to en palis. But for nite, di king nor fit chop, sleep or sey make dem play music for am.
As Jonah dey inside di fish belle, e kon pray to God.
E put am inside en own new grave wey e dig inside rock. Den e roll one big stone kover di grave mout.
So dem karry sojas go guide di grave and dem kon block di grave mout, so dat Jesus Christ nor go fit kom out.