So, dis na wetin mi wey bi God dey tok about Jerusalem profets: ‘I go give dem bitter food chop kon give dem wota wey dem poizin, drink, bikos dem don spread sin for di whole land.’ ”
Di pipol kon ask demsef, “Wetin make us just sidan for here? Make wi run go di strong towns, so dat even if wi go die, den wi go fight die for der. Since di Oga awa God don sey wi go die; E don give us poizin drink, bikos wi sin against am.
So, make yu listin to wetin mi, Israel God wey get pawa go do: ‘I go make dis pipol chop bitter food kon make dem drink di judgement wota wey get poizin.