47 Wi dey fear, bikos wi dey trap; wi don konfuse and distroy awasef.
Wahala don fall for una head; war don skata una land and una pipol dey hongry. E nor get anybody wey go sorry for una.
E send fire kom from heaven and e dey burn inside my bone. E set trap for mi and I fall enter. Naw E don forget mi and I dey sofa well-well.
Jerusalem road dey mourn, bikos nobody dey pass der go celebrate again. Di town gate kwayet and pain won kill di priests dem. Di yong wimen dey kry, bikos di trobol wey dem dey face, too mush!
bikos dat Day go sopraiz evribody wey dey for dis world.