41 Make wi lift awa hand and heart to God for heaven kon sey,
But for yu Job! Make yor heart dey rite before yu koll God.
Make una raiz una hand for di temple kon praiz God!
Make Yu asept my prayers like incense wey dem offa give Yu and di hand wey I take dey praiz Yu, asept am like ofrin wey pipol dey give Yu for evening.
My God, na only Yu I dey depend on.
Make Yu listin to my prayer for mesi as I dey kry to Yu for help and as I lift up my hand for yor holy temple.
I go praiz Yu as long as I dey dis life and I go raiz my hand kon pray give Yu.
My God, make Yu make mi happy, bikos I don give mysef to Yu.
Na mi bi di high and holy God, di Pesin wey go live forever. Where I dey stay, dey high and holy, but I still dey stay with pipol wey dey honbol and ready to turn from sin kom meet mi, so dat I go give dem mind and hope again.
Bikos wi love una, wi dey happy as wi dey share God word and awa own life with una.