Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Lamentashons 3:40 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

40 Instead, make wi shek and test di tins wey wi dey do kon turn from sin kom meet God.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Lamentashons 3:40
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di messenja give evribody for Israel and Judah, di king and di ofisas leta. Wetin di king rite for di leta na, “My pipol Israel, make una turn back kom meet Abraham, Isaak and Israel God, so dat E go kom meet una wey E save from Assyria kings.


If una turn back kom meet God, doz wey karry una relashon go prison, go pity and free dem. Di Oga una God dey sorry for pipol and if una turn back kom meet am, E nor go rijet una.”


Wen I tink as my life bi naw, I kon choose to follow yor ways.


So make yu fear God and nor sin. Make yu tink about am for nite kon turn from yor sins.


Make wiked pipol turn from dia wiked life kon shange di way dem dey tink. Make dem turn go meet di Oga wey bi awa God, bikos E dey sorry for pesin and dey kwik forgive pipol.


bikos e si sey wetin e dey do nor good, so e kon stop to dey sin. E nor go die at-all, but e go live.


So, make una turn kom meet una God. Make una show love; dey judge well and dey patient as una dey wait for God.


I go leave my pipol until dem don sofa well-well for dia sin, den dem go dey look for mi. Yes! Dem go really look for mi bikos dem dey sofa.”


Make una kom make wi turn go meet God! Na-im wound us, but E go heal us! Even doh E wound us, E go bandage awa sore.


but I first go Damaskus, go tell di pipol wey dey der and den, I kon go meet di pipol wey dey for Jerusalem and Judea. Afta, I go meet Gentile pipol sey, make dem turn from sin kom meet God and make dem do tins wey go show sey, dem don really turn from sin kom meet God.


So make evribody shek ensef, before e chop di bread and drink from di cup.


Make una test unasef to know weda una still dey inside di faith; e good make una shek unasef well-well! Una nor know sey Christ dey inside una? May bi una don fail di test!


For dat time, wen una dey trobol and all dis tins don happen to una, una go turn kom meet di Oga una God kon obey all en kommand


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ