4 E don make my skin and flesh old kon break di bones for my body.
My skin don black finish and strong fever dey katch mi naw.
My life bi like wota wey dem trowey and all my bones don skata. My heart bi like kandol wey dey melt inside mi.
Wen I nor gri konfess my sins, my body kon dey die go and I kon dey kry with pain.
My God, make Yu give mi my joy back and make my bones wey Yu break, strong again.
I dey kry evry nite with pain like sey lion dey break my bones, bikos I tink sey God won end my life.
God sey, “Israel pipol bi like sheep wey run skata for evriwhere bikos lion dey porshu dem. Assyria king first attack and kill dem, before King Nebukadnezzar for Babilon kon break dia bones.