Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Lamentashons 3:37 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

37 So, na who fit tok make sometin happen, if God nor allow am?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Lamentashons 3:37
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But di king tell Abishai and Joab en broda, “E nor koncern una. If e curse mi, bikos God tell am make e curse mi, who get di pawa to ask am why e dey curse mi?”


So one Siria soja trow en arrow kon shuk King Ahab for belle. King Ahab tell di man wey dey ride en horse, “Dem don wound mi! Make yu turn komot for here!”


E still dey tok to dem wen di pesin wey dem send, kom tell am, “Di king sey, ‘Na God dey kause all dis wahala for us! Wetin go make mi still dey wait make E kom help mi?’ ”


But na naw I know sey for all dat time, Yu dey plan to wound and kill mi.


But Job tell en wife, “Wetin make yu dey tok anyhow! Wen God give us good tins, wi take am. So naw wey trobol dey, make wi kon curse am?” Even as all dis tins dey happen so, Job nor sin or curse God.


Den Fero tell dem, “I swear with God sey, I nor go let una take una wimen and shidren follow body! E klear sey yu really get wiked plan!


Pesin fit make en own plan, but na God dey direct anytin wey e go do.


Pipol fit plan difren-difren tins, but na wetin God tok, go happen.


Yor wisdom, brain and undastandin nor mean anytin if God dey against yu.


I know di end from di biginnin and na from wen I kreate di world I don dey tok tins before dem happen. I sey na as I plan am, na so e go bi and I go do am as I wont am.


Make una listin to wetin mi wey bi God tok! I hate doz profets wey dey tok dia lie-lie dreams kon lead my pipol komot from di trut. I nor send dem and dem nor dey help my pipol at-all. Mi, wey bi God don tok.”


Yu nor fit kompare God with anybody for dis world. E dey do wetin E like with di angels for heaven and pipol for dis world. Nobody fit shalenge or ask am, “Wetin Yu tink sey Yu dey do?”


Bikos E tell Moses sey, “I go sorry for who I won sorry for and I go show mesi to who I like show mesi to.”


All tins dey happen as God wont am and thru Christ, E choose us to bi en own pipol, bikos na so E plan am from di time wen E kreate di world,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ