16 E don use my face rub groun kon break my tit with stone.
Job sidan outside near dirty kon use breaki-breaki pot take dey skrape en sore.
Wiked pipol dey do like lion, but God go skata and break dia tit.
Na ashes I dey chop as food and my tear dey rush enter my drink,
My God, make Yu get up! My God, make Yu save mi! Yes, Yu go slap all my enemies for dia face kon break dia tit!
So my God, make Yu break dia tit! Make Yu skata di lion jaw.
Bread wey pesin tif dey sweet for mout, but e go bi like stone for en belle.
I still sey, “My pipol! Make una wear sak klot and roll for groun. Make una kry well-well and mourn like sey una only pikin just die. Bikos very soon, doz wiked sojas go kom distroy all of us.”
Wen dia king hear di news, e get up from en throne, remove en fine klot, wear sak kon sidan for ashes.
“E get any of una wey en pikin ask am for bread and e gi-am stone?
“Wish of una wey bi papa go give en pikin snake, if e ask for fish?