1 I bi one pesin wey know wetin e mean wen God ponish yu.
Una wey bi my friends! Make una sorry for mi naw, bikos God don nak mi fall with en hand.
My life dey pass kwik-kwik like shadow for evening and I dey die go like grass.
Even doh Yu don make mi sofa well-well, I know sey Yu go make mi happy again kon take mi komot from di pit wey I dey.
Yor vexnashon dey press mi and yor waves don kover mi.
Pipol rijet am and dem nor like am at-all. E bear sofa and pain well-well. Nobody even sorry am and wi trit am like sey e nor mean anytin.
So dem tie mi with rope kon drop mi small-small for inside Prince Malkijah well wey dey di palis. Di well dry bikos wota nor dey inside.
Evribody wey Nebuzaradan wey bi di sojas oga leave for Gedalaya kare, dem karry dem go Egypt. Dem still karry mi and Baruk follow body.
My heart dey feel pain, bikos my pipol heart heavy; I dey kry well-well and fear dey katch mi.