Lamentashons 2:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
20 Si, Oga God! Why Yu dey ponish us like dis? Make wimen chop dia shidren wey dem love? Or make dem kill priests and profets for inside God temple, bikos of sofa?
E allow Babilon king kill all dia yong men for dia temple. E nor sorry for di yong men or wimen, or even di old pipol. God give all of dem to Babilon king.
Naw, mi, God promise sey, “King Zedekaya with en ofisas and doz wey survive di war, di honga and diziz, I go give dem to King Nebukadnezzar for Babilon and to dia enemies wey won kill dem. King Nebukadnezzar go kill dem with swod and e nor go pity or sorry for dem at-all.” ’ ”
Di profet dem dey lie; di priests dey rule as dem like and my pipol like am like dat. But di day wey wahala and distroshon go start, na where dem go run go for help?
I koll all di pipol wey love mi make dem help mi, but instead, dem kom deceive mi. Na honga kill my priests and leaders for di town wen dem dey find food wey dem go chop.
Bikos of dis, for Jerusalem, papa and mama go chop dia pikin and shidren go chop dia papa and mama. I go ponish una and doz wey go remain wey nor die, I go skata dem for evriwhere for dis world.
I pray to am, “My Oga God, make Yu nor distroy yor pipol wey bi yor betta propaty; pipol wey Yu save with yor own pawa kon take dem komot from Egypt with yor strent.