Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Lamentashons 1:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 My God, make yu si all di wiked tins wey dem dey do. Make Yu ponish dem, just as Yu ponish mi for all my sins. My pains many and e dey make mi sick well-well.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Lamentashons 1:22
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So, my Oga God, make Yu kwik kom ansa mi, bikos my wahala dey worse evriday. Make Yu nor turn from mi, if not, I go die.


Wetin make Yu allow wiked pipol even get mout to ask sey, “Where dia God dey?” Make Yu revensh dis pipol, bikos dem don kill yor savants finish.


So bikos of dis, evry hand go weak and evribody heart go fail am.


Make Yu vex well-well for di nashons wey nor gri woship Yu and doz wey rijet Yu, bikos dem don kill and distroy yor pipol finish kon turn awa land to desert.”


But my God, Yu know all dia plan to kill mi. Nor forget di wiked tins wey dem dey do and nor forgive dia sin. Make dem die for yor front and make Yu ponish dem as Yu dey vex.”


But naw, doz wey distroy una, dem go distroy dem too and dem go karry all una enemies go Babilon as prisonas. Dem go opress doz wey dey opress una and doz wey tif from una, dem go tif from dem too.


Zion pipol sey, ‘Just as Babilon pipol sofa us, na so too God go sofa dem and make God pay dem back, bikos dem kill awa pipol.’ ”


Den I sey, “Nobody fit cure my pain bikos my heart heavy well-well.


E send fire kom from heaven and e dey burn inside my bone. E set trap for mi and I fall enter. Naw E don forget mi and I dey sofa well-well.


Bikos of dis, wi dey feel pain and wi nor dey si well again; awa eyes don dey weak, bikos wi don kry taya.


But if dem do dis kind tin for wood wen e still fresh, wetin go happen wen di wood don dry?”


Na dis make mi tell una sey, make una nor fear bikos of di tins wey I dey sofa, bikos na for una own good.


Dem dey kry with loud vois sey, “Oga God wey get pawa, how long e go take before yu go judge doz wey dey live for dis eart? Make yu ponish dem, bikos na dem kill us!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ