Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Lamentashons 1:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 Jerusalem sey, “God dey rite, bikos I go against en kommand. So pipol for evriwhere, make una listin kon si as I dey sofa! Dem don karry my shidren go Babilon as slave.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Lamentashons 1:18
38 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

and e shaut tell di profet wey kom from Judah, “God sey yu don disobey am, bikos yu nor do wetin E kommand,


Even afta di ponishment wey don happen to us bikos of awa sin, wi still know sey Yu, awa God, dey sorry for us, bikos even doh Yu dey ponish us, Yu still help us survive am.


But with all dis tins, di pipol go against Yu. Dem nor gri obey Yu and dem turn from yor law. Dem kill di profets wey kom warn and tell dem to turn kom meet Yu. Dem curse Yu many-many times,


Yu still dey rite even wen Yu ponish us. Wi really don sin well-well and Yu give us di ponishment wey fit us.


bikos dem go against God word, dem nor gri listin to wetin di Most High God tok


My God, na Yu bi my raitiousness and yor laws good well-well.


My God, I know sey yor laws nor dey bad or hard. Yu dey ponish mi, bikos e dey good for mi.


God dey rite for evritin wey E dey do; na goodness full en body.


So Fero send for Moses and Aaron kon tell dem, “Dis time I gri sey I don sin! God dey holy and na mi and my pipol dey guilty.


My God, Yu dey always trit mi well anytime wey I komplain give Yu. But I ask Yu one kweshon about good judgement: “Why e bi sey wiked pipol dey prosper and pipol wey nor dey honest, dey susid?


But wen dem kom dis land kon dey stay as dia own, dem nor kon dey obey yor kommand or do wetin Yu tish dem; dem nor do wetin Yu orda dem to do and na dis make Yu distroy dem.


Just as pipol dey guide farm, na so di wiked men go surround Jerusalem, bikos en pipol tok against Mi.” God don tok.


God still sey, “Even doz wey I nor suppose ponish, go drink from di ponishment cup. Abi una bin tink sey I nor go ponish una? No! Una must drink from dat cup!


Una wey dey waka pass, my sofa nor mean anytin to una? Make una look round, una si anybody wey dey sofa like mi? But na God vexnashon dey kause dis pain and sofa for mi.


“Wi don sin and go against Yu and na dis make Yu dey vex for us.


Awa crown don fall komot from awa head, bikos wi don sin and naw, wi dey sofa.


Wi don sin! Wi wiked well-well and wi dey do bad tins. Wi nor dey do wetin Yu kommand and wi don turn from yor korrect way.


“Awa God! Na only Yu dey do wetin dey rite, but dem dey disgrace us evriday, bikos Judah, Jerusalem and all di pipol wey Yu skata go evriwhere, nor gri listin to Yu.


For dat day, even strong men and wimen go dey hongry to hear God word.


But God still dey di town and E nor dey do bad at-all. E dey always judge matter well and E nor dey fail. Yet wiked pipol nor dey shame at-all.


But evritin wey I tok thru my profets, happen to una grand-grand papa dem, just as I tok am. So dem turn from sin kom meet mi kon sey, ‘Oga God wey dey lead heaven sojas, na en really ponish us, just as wi deserve am. E don do wetin E sey E go do.’ ”


But una sturbones and strong heart nor let una turn from sin kom meet God, so una dey make una ponishment many more-more, for di Day wen God go judge di world, bikos en na judge wey nor dey support bad tins.


Wi know sey wetin di law tok, na for di pipol wey dey under di law. Di law tok like dis, so dat nobody go get eskuse wen God go judge di world.


Na-im bi di Rock; evritin wey E dey do dey korrect, bikos wayo nor dey en tins. En na God wey pesin fit bilive, bikos E nor just dey judge pipol anyhow.


So Adoni-Bezek sey, “I don kut seventy kings hand and leg komot wons and I make dem chop food from under my tabol. But naw, God don pay mi back for wetin I do to dem.” So, dem karry am go Jerusalem and e die for der.


Bikos to go against am, bi like wen pesin chop witch and to dey show sturbon head, bi like wen yu dey woship juju. So bikos yu don rijet di word wey God tell yu, en ensef don rijet yu as king.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ