Lamentashons 1:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
12 Una wey dey waka pass, my sofa nor mean anytin to una? Make una look round, una si anybody wey dey sofa like mi? But na God vexnashon dey kause dis pain and sofa for mi.
En vexnashon nor go stop until E don do evritin wey E plan to do. Afta sometaim, en pipol go undastand all dis tins. One day, una go undastand wetin I mean.
Di day wen una go face sirious wahala dey kom and dem nor go fit kompare am with any oda day. Even doh di wahala go too mush for my pipol, dem go survive am.”
Jerusalem sey, “God dey rite, bikos I go against en kommand. So pipol for evriwhere, make una listin kon si as I dey sofa! Dem don karry my shidren go Babilon as slave.
Wetin I go fit tok? Who don ever si dis kind sofa before? Wetin I go fit take kompare yu, Jerusalem? How I go fit take konfort yu? Bikos di wound wey yu wound, deep like sea. Na who go fit heal yu?
For dat day, darkness go kover di land and kloud go full evriwhere! Strong-strong sojas go kom and dem go bi like darkness wey spread kover di mountins. Dis kind tin neva happen before and sometin like dis nor go ever happen again.
bikos for dat time, di sofa wey go dey, go strong pass any sofa wey don happen since wen God kreate di world kom rish naw and dis kind sofa, nor go dey again.