Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Kolossians 4:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Make una dey wise as una dey tok with pipol wey nor dey follow Christ. Make una use evry shance wey una get well.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Kolossians 4:5
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So make Yu tish us, so dat wi go know sey wi bi ordinary human being, den awa wisdom go dey grow more-more.


Di king ansa, “I know sey una dey try to waste time, bikos una si sey I don tok wetin I go do.


“Si! I dey send una go like sheep for where plenty wiked animals dey, so make una dey wise like snake and gentol like dove.


E kon tell dem, “God don show una di kingdom sekret. But doz wey dey outside God Kingdom, na parabol e bi for dem,


I dey happy, bikos evribody don know how una dey obey God. But I wont make una dey wise wen e rish matter wey koncern wetin dey good or bad. Make una nor do any bad tin.


Make Christ word stay inside una and make una dey tish each oda with wisdom wey go make una heart strong. Make una dey sing psalms, hymns and spiritual song and dey do all dis tins to really tank God from una heart.


Like dis, doz sinnas go dey respet una and una go get evritin wey una nid.


Pipol wey nor dey di church must dey tok good about di pesin wey bi leader, so dat dem nor go disgrace and make am fall enter devil trap.


But if anybody nid wisdom, make e ask God wey dey gi-am to evribody. E nor go sey, “No,” but E go give yu.


Who get sense among una? Di way di pesin dey bihave go show di gentolness wey wisdom dey bring.


But God wisdom dey pure; e get peace; dey gentol; dey asept pipol and good fruit and mesi full am; e nor dey do wayo or pritend.


Make una wey bi wife, dey obey una husband. Even doh dem nor dey do wetin dem rite for God word, di way una dey bihave, fit make dem shange,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ