Moses tell Aaron, “Dis na wetin God tok: “ ‘Among di pipol wey dey klose to mi, I go show mysef holy to dem and for where evribody dey, na der dem go for honor mi.’ ” So Aaron nor tok anytin.
Make una take kare of unasef and all di pipol wey di Holy Spirit don put under una, bikos na una bi di leaders for God church wey E buy with en only pikin blood.
Make yu wosh as yu dey live yor life and di tins wey yu dey tish. Get patient, bikos if yu dey do like dis, yu go save yorsef and doz wey dey listin to yu.
If yu give all dis kommand to di brodas and sistas, yu go bi good savant for Christ, bikos yu don feed yorsef with God word, wey bi di spiritual food and naim bi di good tishing wey yu dey follow.
Timoti, make yu guide wetin God give yu well-well. Nor put yor mout for yeye tins or matter wey pipol wey nor know God dey tok and do, bikos dem dey oppoz yu with wetin dem feel sey dem know.