7 Na so una dey live una life before wen una bi sinnas,
Wen wi still dey di world, di law dey make us do bad tins wey awa body wont and all dis tins dey bring deat.
Na so some among una bi before, but naw, God don wosh una klean thru Jesus Christ name and en Spirit pawa, don make una klean for en eye.
bikos una dey do wetin di world wont. Una dey obey wiked pawas wey dey rule di air and kontrol sturbon shidren.
Even doh una bin don die inside una sin bikos dem nor sekonsaiz una body, God kon make una dey alive with am, bikos E don forgive una sins.
Before naw, wi dey bihave like fool; wi nor dey obey; wi dey deceive pipol; wi bi savant to tins wey dey sweet us; wi dey do bad tins and dey jealous odas; pipol hate us and wi hate dem too.