Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Kolossians 3:23 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

23 Anytin wey una dey do, make una do am with all una body, like sey una dey do am for Christ and nor bi for pipol,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Kolossians 3:23
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Evritin wey e do to take serve God well for en temple and to follow God laws and kommands, Hezekaya do dem with e whole heart and bikos of dis, God kon make am prosper.


My soul, make Yu praiz God! Make evritin wey dey inside mi, praiz en holy name!


I don try well-well to find Yu. Abeg, make Yu nor let mi go against yor kommand.


My God, make Yu ansa mi, bikos I dey pray with all my heart, so dat I go always dey obey yor laws.


Make Yu make mi undastand and I go obey evritin wey Yu tok kon learn dem with all my heart.


So, anytin wey yu dey do, make yu do am well, bikos wons yu die, yor wisdom, knowledge, work and plans, nor go mean anytin again.


Even with all dis tins, Israel sista wey bi Judah nor gri turn kom meet mi with all dia heart, but dem just dey pritend.” Oga God don tok.


“Wen una dey fast, make una nor skwiz una face like pipol wey dey pritend, so dat pipol go si sey dem dey fast. I tell una true word, dem don already get dia full reward.


Anybody wey tink sey one day betta pass anoda, dey do so to honor God. And anybody wey chop meat, dey tank God just like di pesin wey nor won chop.


If wi live, na God wi dey live for; if wi die, na God wi still die for. So, weda wi die or wi live, na God still get us.


Una wey bi wife, make una dey respet una husband, just as una dey respet Christ,


For anytin wey una dey do, weda una dey tok or do oda tins, make una do am with awa Oga God Jesus Christ name and tank God thru am.


Una don klean una soul with di trut wey una dey obey and as brodas and sistas, make una love each oda well-well.


Make una dey obey una leaders bikos of Christ. Weda dem bi kings wey get pawa


Bikos God wont sey, wetin una dey do, go make di pipol wey nor get sense shut up dia mout.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ