So as far as wi dey live dis yuzles life wey God give us, make wi enjoy am with awa wife, bikos dat na awa reward for all di trobol wey wi dey face for dis world.
Husbands, make una dey trit una wife with soft hand, bikos una know sey dem nor strong rish una; make una respet dem as pipol wey get God grace and life. If una dey do like dis, nor-tin go block una prayers.