Na mi bi di high and holy God, di Pesin wey go live forever. Where I dey stay, dey high and holy, but I still dey stay with pipol wey dey honbol and ready to turn from sin kom meet mi, so dat I go give dem mind and hope again.
“I don tell una all dis tins, so dat my peace go stay with una. Wahala full inside di world and sofa dey too, but make una heart dey strong, bikos I don already win di world.”
Even doh dem know sey God dey, dem nor dey gri gi-am glory as God. Dem nor dey tank am for all di tins wey E dey do. Instead, na nonsense tins dem dey do and dia wiked mind nor fit undastand di trut again.
But if di one wey nor bilive komot from di marriage, make e bi like dat. For dis kind kase, di broda or sista wey bilive, don dey free; bikos God wont make wi enjoy peace.
Na from Christ di whole body dey grow well and join togeda thru di pawa wey dey support am. As each part dey do en work, na so di body go dey grow inside God love.