Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Kolossians 3:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 So, as pipol wey God don choose, wey holy and wey E love well-well, make una kwik dey sorry for pipol; dey gentol; nor dey karry body up and wear patient like klot for body.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Kolossians 3:12
50 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God sey, “Na my savant wey I give pawa bi dis; di pesin wey I choose and I dey happy with am. I don put my Spirit inside am and e go judge di nashons well.


I koll yu bikos of Jakob shidren-shidren wey bi my savant and Israel pipol wey I don choose. I don give una great honor, even doh una nor know mi well.


Oga God! Make Yu look us from heaven, yor holy place where Yu dey stay wey get glory. Where yor pawa and strong mind dey? Where yor love and mesi dey? Make Yu nor leave us at-all.


Anoda pesin nor go stay inside di house wey dem build and odas wey nor plant, nor go drink di wine wey my pipol make, bikos my pipol go get long life like tree and dem go enjoy evritin wey dem work for.


I go bless Israel pipol wey kom from Judah tribe and na dia shidren-shidren go stay my land. My pipol wey I choose wey serve mi, na dem go stay for der.


So God ansa, “Israel, una bi my shidren wey I love well-well. I dey always tink of una with love wen ever I remember una name. Una dey for my heart and I go really sorry for una.


I go kom help dem, bikos I love Israel pipol well-well and na dis make mi still dey show dem my love wey nor dey end.


“ ‘ “As I dey waka pass again, I kon si sey di time wey yu suppose to undastand wetin love mean, don rish. So, I kover yor naked body with my klot kon promise sey I go always love yu. Yes, I marry yu and yu kon bi my own.” ’ ” Dis na wetin God wey get pawa dey tok.


And if God nor reduce di days wen dis tins go happen, evribody go die finish. But bikos of di pipol wey God choose, e go reduce di days.


Lie-lie messiahs and profets go kom do big-big mirakles take deceive pipol. If e possibol sef, dem go deceive pipol wey God choose.


God go send en angels go blow loud trumpet and dem go gada di pipol wey E choose from evriwhere for di world.”


If God nor kut doz days short, nobody go save. But bikos of di pipol wey God don choose, E don make doz days short.


Bikos fake christs and profets go kom and dem go do signs and mirakles wey bi like majik to deceive pipol. If to sey e possibol, dem go deceive di pipol wey God don choose.


Den, God go send en angels go gada di pipol wey E don choose from di for korna for di world go rish heaven.”


Since God love and en kindness strong well-well, E go let en salvashon rish us,


una nor tink sey God go help en pipol wey dey kry to am both day and nite? Abi, God go wait tey before E help dem?


Rome pipol wey God love and koll make dem bi en own, na una I dey rite dis leta give. Make God awa Papa for heaven and Jesus awa Oga God give una grace and peace.


Instead, make una wear Jesus Christ like klot for body. Den wi nor go do di tins wey awa body wont.


Even before dem born di shidren or sey dem do any bad or good tin, God tell Rebekah, “Di senior pikin go serve en junior broda, so dat my promise go stand:


Love dey kind and patient, e nor dey jealous or boast


Wi dey do all dis tins with awa klean life, di tins wey wi know; di patient wey wi get; di good wey wi dey do for pipol; di Holy Spirit wey wi get; betta love wey wi show pipol;


For Christ, e nor matter weda dem sekonsaiz pesin or not; di only tin wey matter, na faith wey dey work thru love.


Before God kreate di world, E choose us thru Christ bikos E love us, so dat for en front, wi nor go get any fault and wi go dey holy.


Make una dey get pity for one anoda with kwayetnes, gentolness and patient, bikos of di love wey una get.


Den, true raitiousness and holiness wey di trut dey bring, make una wear di new man wey God don kreate like ensef.


Make una dey good to one anoda; dey sorry for pipol and dey forgive each oda, just as God forgive una thru Christ.


God know sey, bikos of Christ love wey dey my heart, I dey miss una well-well.


Make una wear di new pesin, so dat una go dey new as una dey learn to know and bi like di Pesin wey kreate una.


Make una dey sure sey nobody pay bad for bad, but for evritime, make una always dey do good for each oda and for evribody.


Bikos God save and koll us to live holy life. E do like dis, nor bi sey wi deserve am bikos of wetin wi do, but na so E plan am even before di world start, so dat wey go know en grace thru Jesus Christ.


So I dey ready to bear di sofa, as long as e go save doz wey God don choose inside Christ with glory wey go dey forever and ever.


Na Paul, wey bi Jesus Christ apostle and God savant rite dis leta to help pipol wey God don choose, so dat dia faith go strong kon know di trut wey go help dem live di kind life wey God wont.


make dem dey holy thru en Spirit. Make una dey obey Christ for evritin and en blood go klean una. Make grace and peace bi una own!


So my brodas and sistas, make una do evritin to show sey, God koll and choose una. As una dey do so, una nor go ever fall inside sin.


Bikos God first love us, naim make us dey fit love each oda.


Una sista shidren wey God don choose, dey greet una.


Dem go follow di Lamb fight war, but di Lamb go win dem, bikos na en bi Oga God for all ogas, King for all kings and pipol wey dey follow di Lamb, na doz wey e koll, choose and save.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ