Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Kolossians 2:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Bikos na Christ dey show us evritin about God.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Kolossians 2:9
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So, God go give una sign by ensef. One yong woman wey neva ever sleep with man before, go get belle kon born boy pikin and dem go koll am, ‘Immanuel, wey mean, “God dey with us.” ’


“Si! Di woman wey neva sleep with man before go get belle and e go born boy and dem go koll am, ‘Emmanuel’ wey mean, ‘God dey with us.’ ”


“Afta, di savant sey, ‘Oga God, I don do wetin yu tok and di party neva still full.’


di Holy Spirit kom down for en head like dove. Den one vois tok from heaven sey, “Yu bi my Pikin wey I love well-well and yu dey make belle sweet mi.”


Den di Word kon shange to pesin and e stay with us for dis world. Wi si en glory wey show sey, naim bi di only pikin wey get korrect favor and trut, wey God send kom meet us.


Evribody for dis world don receive plenty good tins from am.


But if I dey do dem, even if una nor bilive mi, make una bilive di tins wey I dey do, so dat una go know and undastand sey, I dey inside my Papa and my Papa dey inside mi too.”


Dat time, una go know sey I dey inside my Papa and una dey inside mi, as I dey inside una.


Papa, I dey pray, so dat all of dem go get one mind, just as mi and yu bi one. I still dey pray make dem dey with us, so dat di world go bilive sey na yu send mi.


But na di temple for Jesus body naim e dey tok about.


So, as e bi sey wi bi God pikin, make wi nor tink sey God bi like image wey human being use gold, silva or stone take make.


So, bikos of Christ, God dey turn di world from en enemy, to en friend. E nor dey kount pipol sins against dem and E don give us di message wey go make pipol bi en friend.


God dey happy sey evritin wey dey inside am, dey inside en pikin too


Wi know sey God ways dey great well-well: Christ kom as human being; di Spirit show sey e dey free; angels si am wen e kom prish among Gentile pipol; pipol bilive am for di world and God karry am go heaven with glory.


bikos wi dey wait for di day wen God sey Christ, wey bi awa God Almighty and Savior, go kom.


Wi know sey God Pikin don kom and e don give us sense to know di trut about God. And wi dey inside en Pikin Jesus Christ. Na-im bi di real God and na-im bi di life wey nor go end.


Wi get three witness to show sey wetin wi dey tok, na true and dem bi:


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ