Kolossians 2:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English16 So make una nor let anybody take food, drink, party, new moon or Sabat Day matter, take judge una. အခန်းကိုကြည့်ပါ။ |
Anytime dem dey woship for di temple, wi go provide dis tins: di holy bread, di korn wey dem dey give evriday as ofrin, di animals wey dem go burn as sakrifice for each day, di holy ofrins for Sabat Day, di new moon festivals and oda festivals, di oda holy ofrins, di ofrin wey go remove Israel sins and anytin wey dem nid for di temple.
Wen di pipol hear wetin dem read for di law, di word tosh dem sotey dem kon start to kry. So Nehemaya wey bi di govnor, Ezra wey bi priest wey know di law well-well and Levi pipol wey dey esplain di law kon tell all di pipol, “Today dey holy for di Oga wey bi una God, so una nor suppose mourn or kry.