Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Kolossians 2:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 God disgrace wiked and evil rulers for publik, wen E win dem for di cross.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Kolossians 2:15
25 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I go make yu hate woman and yor pikin go still hate pikin wey woman born. Pikin wey woman born go mash yor head and yu go bite dia leg.”


God klimb go where high well-well. E don katch and put many pipol for prison. Even men wey sin well-well dey praiz Yu. True-true, di Oga awa God dey stay for der!


So, I go honor and put am for where great men dey, bikos na only en sakrifice en life and dem si am as sina too. E karry evribody sins for en head kon pray so dat God go forgive us.


“How pesin go fit break enter strong man house kon tif en propaty, unless e first tie di strong man? Den, e go get shance tif wetin dey di house.


Jesus tell dem, “I si Satan wen e fall like tunda-lite from heaven.


But wen pesin wey get pawa pass am attack and win am, di pesin go karry all di tins wey di man take dey protet ensef kon divide di propaty wey remain.


And dem dey wrong about judgement, bikos God don kondemn di pesin wey dey rule dis world.


Wen e don taste di wine, Jesus kon sey, “Evritin don finish.” Den e bend en head down, kon die.


Den afta Christ don distroy all pawas, di world go end and e go give di kingdom to God wey bi di Papa.


But make wi tank God wey make us winners inside Christ. Bikos thru us, many pipol don know tins about Christ, like betta perfume wey dey smell for evriwhere.


bikos doz wey nor bilive, di gods for dis time don blind dia mind, so dem nor go si lite wey dey dis gospel wey get glory and dis gospel na Christ wey bi God image.


E make dem undastand, so dat thru di church, all di rulers and pawas wey dey heaven go kon know God komplete wisdom, wey dey show ensef for difren ways.


Na dis make dem sey, “Wen e raiz-up go heaven, E karry many prisonas wey E free follow body and E give plenty gift to pipol.”


Bikos, wi nor dey fight against human being, but na against di wiked rulers wey dey for dis world, against evil spirits and pawas wey dey di heavens.


Bikos God kreate evritin for heaven and eart thru en pikin; both Fisical and spiritual tins; weda dem get pawa or dey rule for difren-difren place; God kreate dem thru am and E kreate dem for am.


And una dey komplete inside am; bikos na-im bi di head for all di pawas wey dey for heaven and eart.


So as di shidren get flesh and blood, en too get flesh and blood like dem, so dat thru deat, e go fit distroy Satan wey get pawa to kill


Dis dragon na di old snake wey bi di devil or Satan, wey dey deceive di world. Dem trow am kom down from heaven with en angels.


Den, dem go trow di devil wey deceive pipol inside God fire. Den di beast and en fake profets go sofa both day and nite forever and ever.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ