8 and e kon tell us about di love wey di Spirit give una.
E nor get wetin pipol hide wey God nor go show and e nor get wetin dey for sekret naw, wey nor go kom out for open.
My brodas and sistas, I dey beg una with Jesus Christ and di Holy Spirit love; make una help mi pray to God.
Dis hope nor dey disappoint pesin at-all, bikos God pour en love like river wey dey flow inside awa heart, thru di Holy Spirit wey E give us.
But di fruit wey di Holy Spirit dey bear inside us; na love, joy, peace, patient, kindness, goodness, faithfulnes,
since wi hear about how una bilive Christ and di love wey una get for God pipol.
Bikos God nor give us di spirit wey go make us fear, but di spirit wey E give us, get pawa, love and sef kontrol.
Una don klean una soul with di trut wey una dey obey and as brodas and sistas, make una love each oda well-well.