Kolossians 1:27 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
27 God wont make dem know di rishis wey dey en glory; wey di sekret get for evribody and na-im bi Christ wey dey inside una. So una get hope sey una go share for God glory.
Naim bi di Spirit wey dey tok trut, wey pipol for dis world nor go fit receive, bikos dem nor fit si am or know am, but una know am, bikos e dey stay inside una.
But make wi tank God wey make us winners inside Christ. Bikos thru us, many pipol don know tins about Christ, like betta perfume wey dey smell for evriwhere.
Bikos God wey sey, “Make lite shine from darkness,” Na-im dey shine inside awa heart, so dat E go give us di lite wey show us en glory wey dey Christ face.
Wish kind business God Temple and juju get? Bikos wi bi God Temple, just as God sey, “I go stay inside dem and waka among dem, den, I go bi dia God and dem go bi my pipol.”
I don die with Christ for cross, so nor bi mi dey live again, but na Christ dey live inside mi. Di life wey I dey live naw, na bikos of di good tins wey God pikin do inside mi, bikos e love and die for mi.
For heaven, e nor get anytin like Greek or Jew pesin; pesin wey dem sekonsaiz or not; bush pesin; pipol wey dey chop human being; slave or free pesin, but na Christ bi all and e dey inside all of us.
Dis hope strong for awa heart like ship wey dem tie make e nor for move, bikos di hope wey wi get dey kamkpe and strong gidigba. Di promise go take us pass di curtain for heaven, until wi rish where God dey;