Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Kolossians 1:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 So di sekret wey E hide from awa grand-grand papa dem and evribody wey dey di world before, E don open am make en pipol si.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Kolossians 1:26
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God na friend to doz wey dey fear am and E dey tish dem en kovenant.


Jesus ansa dem, “God don make una know all di sekret tins about en kingdom, but dis pipol nor know.


“Dem ansa am, ‘Na bikos nobody hire us.’ “E kon tell dem, ‘Make una enter my farm go work.’


E kon tell dem, “God don show una di kingdom sekret. But doz wey dey outside God Kingdom, na parabol e bi for dem,


Jesus ansa dem, “Una get di shance to know God Kingdom sekret, but dis oda pipol, na only parabol dem go take hear am, so dat “As dem dey look, dem nor go si and as dem hear, dem nor go undastand.


Di tin wey I dey tok about, na God sekret wisdom wey E choose for us, even before E kreate di world.


Wetin I wont bi sey, wen una don really undastand God sekret wey dey inside Jesus Christ, make una heart dey strong with love, so dat una go get evritin wey una wont.


Like dis too, make una dey pray for us, so dat God go give us betta shance to tok about Christ sekret, wey make mi dey prison.


But naw, E don bring all dis plan out wen awa Oga God Jesus Christ kom dis world. E distroy deat pawa kon bring life wey nor dey end thru di gospel.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ