Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Judges 9:57 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

57 God still pay Shekem pipol back for di bad-bad tins wey dem do. And di curse wey Jotam, Jerub-Baal (wey bi Gideon) pikin curse dem, really follow dem.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Judges 9:57
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Even doh na mi God choose to bi king, I dey weak today, bikos dis Zeruaya shidren too sturbon for mi. Make God ponish dis tif, bikos of wetin dem do!”


For di time wey e bi king, Hiel wey kom from Bethel kon build Jeriko again. As God don tok thru Joshua wey bi Nun pikin, Hiel first pikin, Abiram, die wen dem start to build Jeriko foundashon and en last born, Segub kon die wen dem dey won put di town gate.


God go ponish Joab for doz pipol wey e kill, wey David my papa nor know about. Joab kill two innocent men wey betta pass am: Abner wey bi Israel soja kommander and Amasa wey dey kommand Judah sojas.


So, I go tank God, bikos E dey judge well; I go sing and praiz di Most High God.


So God go pay evil and wiked pipol back, E go distroy dem, bikos of dia sins. True-true, di Oga awa God go distroy dem.


Wiked man sins na trap, bikos na en own sin net, go katch.


But evil pipol own don finish, bikos na wetin dem do pipol, God go do dem too.


For dat time, Joshua kon swear sey: “Anybody wey sey e won build Jeriko town again, God go kondemn am. “E first boy pikin go die as e stay to build am and en last boy pikin go die wen e dey put di gate!”


So Adoni-Bezek sey, “I don kut seventy kings hand and leg komot wons and I make dem chop food from under my tabol. But naw, God don pay mi back for wetin I do to dem.” So, dem karry am go Jerusalem and e die for der.


Afta Abimelek don die, one day, Tola wey dey stay Shamir for Efraim hill kountry, wey Puah bi en papa and na Dodo wey kom from Issakar tribe bi en grand-papa, kon save Israel pipol.


But if e nor dey good for una eye, make Abimelek burn Shekem and Bet-Millo men with fire. Den fire go kom out from Shekem and Bet-Millo kon burn and kill Abimelek too.”


Dis tin happen so dat, Abimelek and di men for Shekem wey enkourage am to kill Gideon 70 shidren, go sofa for wetin dem do.


Thru-out dat day, Abimelek fight for di town. E kill all di pipol for di town kon seize am. Den e skata di town kon pour salt full di groun.


God pay Abimelek back for di bad tins wey e do to en papa, bikos e kill en 70 brodas.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ