56 God pay Abimelek back for di bad tins wey e do to en papa, bikos e kill en 70 brodas.
If anybody kill pesin, I go ponish am. I go kill any animal wey kill human being.
“Na as God bi, dem make man, so anybody wey kill pesin, na so too anoda pesin go kill-am.
Shebi trobol na for doz wey dey do bad tins and wahala for wiked pipol?
E go burn wiked pipol with shako, sulfur and fire kon distroy dem with strong breeze.
Bikos di Pesin wey dey ponish doz wey kill pipol, still dey kare for doz wey nor get helpa. E nor dey leave pipol wey dey sofa.
So God go pay evil and wiked pipol back, E go distroy dem, bikos of dia sins. True-true, di Oga awa God go distroy dem.
Wiked man sins na trap, bikos na en own sin net, go katch.
Bikos as una dey judge, na so God go take judge una. And as una dey do to oda pipol, na so dem go do una too.
Wen di pipol wey dey stay der si sey di snake put e mout for Paul hand, dem kon dey tell demsef, “E bi like sey dis man hand nor klean! Even doh e nor die inside sea, hand don still tosh am for here!”
Make una nor let anybody deceive una. Nobody go fit deceive God. Anytin wey pesin plant, naim e go reap,
Dis tin happen so dat, Abimelek and di men for Shekem wey enkourage am to kill Gideon 70 shidren, go sofa for wetin dem do.
Wen Israel pipol si sey, Abimelek don die, dem kon go back to dia house.
God still pay Shekem pipol back for di bad-bad tins wey dem do. And di curse wey Jotam, Jerub-Baal (wey bi Gideon) pikin curse dem, really follow dem.