25 Shekem leaders hide some men for bush dey wait Abimelek and to rob anybody wey pass der. But Abimelek kon know about dia plan.
Dem dey hide wait for di village gate; where nobody go for si dem kon kill innocent pipol and dem dey always fine and wound pipol wey nor get help.
E tell dem, “Make una hide for di town back. Make una nor too go far from di town and all of una must dey ready!
Dis tin happen so dat, Abimelek and di men for Shekem wey enkourage am to kill Gideon 70 shidren, go sofa for wetin dem do.
So wen Gaal, Ebed pikin kom Shekem with en brodas, di men for Shekem kon put dia hope on am.