8 So Gideon go Penuel go meet di pipol wey dey der kon beg dem for di same tin, but dem ansa am, just like Sukkot leaders.
Dat na why till today, Israel pipol nor dey chop di meat wey dey lap, bikos di man tosh Jakob lap.
King Jeroboam for Israel, guide and build wall round Shekem town, wey dey di hill kountry for Efraim kon stay der for sometaim. Den e komot for der kon go build and guide Penuel town.
God angel sey, ‘Make una curse Meroz pipol. Make curse follow dem, bikos dem nor gri help God pipol; dem nor kom fight for dem.’
Make I give una di bread, wota and meat wey I won give doz wey dey barb di sheep? I nor even know where una from kom!”