Dem katch two Midian shief wey bi, Oreb and Zeeb. Dem kill Oreb for Oreb rock and Zeeb for where dem for dey press wine and di place name na Zeeb. Israel pipol still porshu Midian pipol, but dem bring Oreb and Zeeb head kom give Gideon for Jordan River east.
Si, na una use God pawa take kill Midian pipol two shief, wey bi Oreb and Zeeb. Wetin I do wey rish dat one?” Wen e tok like dis finish, di pipol kon stop to vex.
So David ask God, “Make wi porshu dem? Wi go katch dem?” God ansa, “Make una porshu dem, una go true-true katch dem kon diliver una wifes and shidren.”