29 Gideon go back to en own town kon stay der.
From dat time go, dem kon dey koll Gideon, “Jerub-Baal,” bikos Joash sey, “Make Baal defend ensef, bikos na en altar dem distroy.”
One day, Gideon and en men get up for early morning kon go stay near Harod where wota dey flow pass. Midian pipol kamp dey for di valley near di nort side wey divide dem from Moreh hill.
So Israel pipol win Midian pipol and dem nor kon dey fear dem again. Di land kon get peace for forty years until Gideon die.
So, God send Jerub-Baal, Barak, Jeftah and Samuel and E kon save una from una enemies.