22 Leta, Israel pipol tell Gideon, “Make yu bi awa ruler, yu and yor shidren-shidren, bikos yu don save us from Midian pipol hand.”
So wen Midian tradas dey pass, Josef brodas karry am komot di gutta kon sell am give Ishmael pipol for twenty silva. Den dem karry Josef go Egypt.
Since Jesus know sey dem go won take am by force go make am dia king, only en kon komot go on-top di mountin alone.
So Zebah and Zalmunna kon tell Gideon, “Make yu kill us yorsef, bikos yu nid to get heart like man first, before yu go fit do wetin man dey do.” So Gideon kill dem kon take di gold wey dey dia kamel neck.
But Gideon ansa, “I nor go fit bi una ruler, even my pikin nor fit. Na God go bi una ruler.”
“Wen una si sey King Nahash for Ammon dey kom fight una, una sey, ‘No! Wi wont king’, even doh na di Oga una God bi una king!
kon tell am, “Si, yu don old and yor shidren nor dey do as yu dey do. So make yu choose king wey go lead us, just as all di oda nashons get.”