Wen dem bring di kings kom meet Joshua, e koll Israel men kon tell di sojas oga wey dey with am sey, “Make una kom here kon mash dis kings for dia neck.” So dem kom put dia legs for di kings neck.
So Zebah and Zalmunna kon tell Gideon, “Make yu kill us yorsef, bikos yu nid to get heart like man first, before yu go fit do wetin man dey do.” So Gideon kill dem kon take di gold wey dey dia kamel neck.
Samuel kon sey, “Just as yor swod kill pipol shidren kon make some wimen nor get pikin again, na so yor mama nor go ever get pikin again.” Den Samuel kut Agag to pieces for God present for Gilgal.