12 Di two Midian king wey bi Zebah and Zalmunna run komot, but e porshu and katch dem and dis tin kon make all di sojas sopraiz.
E nor dey support rulers or rish pipol against poor pipol, bikos na-im kreate all of dem.
Make di mighty ones among dem die like Oreb and Zeeb. Make all di prince die like Zebah and Zalmunna
Yu don make di pipol plenty kon give dem great joy. Dem dey happy for yor present, just as doz wey dey harvest wetin dem plant dey happy or as sojas dey celebrate wen dem divide wetin dem karry kom from war.
Even doz wey dey run fast nor go fit eskape; strong men nor go get pawa again and sojas nor go fit save dia own life.
I si Kushan pipol dey fear and as Midian pipol dey waka dem kon dey fall.
Gideon pass di road wey dey di desert korna for di east side for Nobah and Jogbehah kon go attack di sojas for der.
Wen Gideon dey kom back from di war, e kon pass thru Heres Pass and