10 By dat time, Zebah and Zalmunna and dia soja, dey Karkor. Dem bi only 15,000 wey remain from all di men wey dey di desert tribe and dem don kill 120,000 of dia soja.
All dis joy na bikos Yu don remove dia heavy load and di kane wey dem take dey flog dem. Yu don defeat di pipol wey dey tif and opress oda pipol, just as Yu bin defeat Midian sojas.
Wen Gideon rish der, e hear one man dey tell en friend about di dream wey e dream kon sey, “I dream sey, bread wey nor get yist roll enter awa kamp kon nak and skata awa tents for groun.”
Wen Gideon men dey blow dia trumpet, God make di enemies bigin fight demsef with dia swod. So dem run go Zaretan, wey far rish Bet-Shittah and Abel-Meholah town, near Tabbat.