Den I tink of all di work wey pipol dey do and I kon si sey, evritin wey dem dey do, na to know who betta pass. But all dis tins dey yuzles too, e just bi like wen pesin dey porshu breeze.
Before-before, wen Efraim pipol dey tok, di oda tribes for Israel dey fear and respet dem. But naw, Efraim pipol dey woship Baal juju and dis tin kon distroy dem.
But e tell dem, “Make una nor vex! Even doh una nor kwik kom, wetin una do still big pass di ones wey mi and my men do. E just bi like wen dem harvest grape: di grape wey Efraim tribe waka leave for groun, betta pass all di ones wey Abiezer harvest!