Una nor go fight for dis war. Make una just stand kon si how God go diliver una wey bi Judah and Jerusalem pipol. Make una nor fear, make una go fight dem tumoro, bikos God dey with una.”
As e dey tink how e go take leave am, God angel show ensef to am for dream kon tell am sey, “Josef, David pikin, make yu nor fear to marry Mary, bikos di pikin wey dey en belle, na Holy Spirit gi-am.
Wen di wise men don go, God angel kon tell Josef for dream, “Get up, karry di pikin and en mama run go Egypt, make una stay der until I go tell yu wetin una go do, bikos Herod won kill di pikin.”
God tell Joshua, “Make yu nor fear dem, bikos by dis time tumoro, I go distroy dem for Israel pipol front. Yu must cripple all dia horse kon burn dia shariot.”
and na Finehas, wey bi Eleazar pikin and Aaron grand-pikin, bi di priest wey dey kare for am). Den Israel pipol ask God again, “Make wi go fight against awa rilative for Benjamin tribe or not?” God ansa. “Make una go! Tumoro, I go give dem to una.”
E tell dem, “Make una follow mi, bikos God don give una viktory ova una enemies, (Moab pipol).” So dem follow am kon seize di place wey Moab pipol dey pass cross go Jordan River and dem nor allow anybody cross.
So Gideon send di men go dia house, escept di three hundred men wey follow di rules and na dem dey keep di trumpets. Midian pipol kamp dey under Israel pipol own for di valley.