17 E tell dem, “Wen wi rish di kamp korna, make una do anytin wey I do.
Den Jesus tell en disciples, “If anybody won follow mi, e must deny ensef, karry en cross and follow mi.
Make una follow mi as I dey follow Christ.
Make una remember una leaders wey tish una God word; make una tink about di kind life wey dem dey live, den make una follow dia faith.
And make una nor dey opress God pipol wey dey under una, instead make una bi ezample to dem.
E divide en three hundred men into three groups kon give each pesin trumpet and cup wey tosh dey inside.
And as mi and my group blow awa trumpet, make una blow una own round di kamp kon shaut, ‘Dis one na for God and for Gideon!’ ”
so en and en men go on-top Mount Zalmon. E take axe for en hand kon kut one branch from one tree. E put am for en shoulder kon tell en men, “Make una kwik-kwik do wetin una si mi dey do!”