15 Wen Gideon hear di dream and wetin e mean, e knee down kon woship God. Den e go back to en kamp kon sey, “Make una get up! Bikos God don give us viktory ova Midian sojas.”
Dem ansa, “Wi dream one kind bad dream, but e nor get anybody wey fit tell us wetin di dreams mean.” Josef ansa, “Nor bi God dey tell pipol wetin dreams mean? Make una tell mi di dream.”
E tell dem, “Make una follow mi, bikos God don give una viktory ova una enemies, (Moab pipol).” So dem follow am kon seize di place wey Moab pipol dey pass cross go Jordan River and dem nor allow anybody cross.
Deborah tell Barak, “Make yu ready, bikos God dey lead yu and today E go give yu viktory ova Sisera.” So Barak kom down from Mount Tabor with en 10,000 men.
So di friend ansa, “True-true, Gideon, Joash pikin wey kom from Israel, na en swod bi dat o-o! Na wetin di dream mean bi dat! God don gi-am viktory ova Midian pipol and all awa sojas.”
Den Filistia sojas wey dey for Mikmash road kon tell Jonatan and en savant, “Make una kom meet us, so dat wi go show una pepper!” Den Jonatan kon tell en savant, “Make yu follow mi for back, bikos God don give dis men to Israel!”